JOKE OF THE DAY.

E get one particular restaurant wey i dey go chop Amala at the back of OLOFA Palace OFFA. E get one Oyinbo man wey dey always come chop there too...
Anytime dis Oyinbo man chop finish, he go shout ''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout. I decided to chop wetin d Oyinbo man dey always chop so maybe me self go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin d man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am finish, i no shout.
I collect extra plate, but i no still shout. I say dis Oyinbo man na mumu dey worry am self or he be were', wetin dey make am shout like dat? Na so i just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d extra plate too na another N75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!! heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy................Up till now, I still dey shout .... ooo..

No laugh alone make someone laugh with u too by sharing this post bcoz Federal Ministry of Health warn that laugh is good for health!!!

Comments